Nigerians get another alternative instead of PDP and APC – Kwankwaso
Di presidential candidate of di New Nigeria Peoples Party, Rabiu Kwankwaso, don promise say di success wey dem record for Kano when hin be di di governor, go be di same if Nigerians elect am as president. For some parts of hin statement, hin yarn say e dey happy as Nigerians get another alternative instead of PDP and APC.
Kwankwaso tok this one for Abuja on Monday for hin second presidential town hall meeting. Di meeting dey organized by di Department of Political Science of di University of Abuja.
Hin lament say Nigeria dey face serious crisis for di education sector, from primary to tertiary education levels, and hin tok say di All Progressive Congress and Peoples Democratic Party don fail Nigerians.
Kwankwaso yarn say hin dey very happy say Nigerians get alternative to di failure of All Progressives Congress and Peoples Democratic Party.
FOR MORE NEWS: Ogun State Government don announce work-free days for PVC collection.
Hin tok say hin administration go address di issue wey dey education sector because e dey critical.
For dia manifesto, hin tok say once person pass JAMB, e go stay for four years. Person no need to go do another exam because dem believe say government must take responsibility so that sons and daughters of di poor go get equal opportunities to go university.
ed.
Di Vice Chancellor of UNIABUJA, Prof Abdul-Rasheed Na’Allah, advise all di presidential candidates make dem come tell Nigerians about why they want rule di country.
He lament say despite di abundance of mineral resources for Nigeria, di country still dey battle with issues like electricity wey no stable, and a poor healthcare system while roads be death trapped.