fbpx
May 2, 2024

power outage interrupt APC rally for Bauchi State

power-outage-interrupt-APC-rally-for-Bauchi-State

Di presidential campaign rally of di All Progressives Congress for Bauchi State no go well at all on Monday. This na because of di power outage wey interrupt rally.

Dem bin dey do di rally for di Abubakar Tafawa Balewa Stadium, Bauchi, when di power supply just cease. As if that one no dey enough, di sound system sef off and e no kon work again.

Di time wey di Chairman of di Progressives Governors’ Forum, Atiku Bagudu, wan make hin speech at 12.20pm, di power outage interrupt am too.

After dem restore di power supply, hin return back complete hin speech.

But again, at exactly 1.10pm, di power supply off, just as di APC National Chairman, Abdullahi Adamu, mount di podium. Di interruption no allow am address di party supporters.

FOR MORE NEWS: Nigerians get another alternative instead of PDP and APC – Kwankwaso

Di pipo wey bin dey di podium with di national chairman na, di APC standard bearer, Bola Tinubu, his running mate, Kashim Shettima and his wife Nana. Buhari wey sit down for di VIP (Very important persons’) section of di stadium, bin dey with make dem restore di electricity.

Adamu, Tinubu, Shettima and others bin still dey di podium when dem restore di power supply. E no too tey again before e off for di third time and all dem bin no fit restore di power supply again. Na so di power outage interrupt di APC rally.

Also, di party standard bearer no fit kon address di mammoth crowd for di  rally, following di departure of di President.

Buhari bin don land for Bauchi so that hin go lead di APC presidential and governorship campaign rally.

You fit go read di full tori…READ MORE