Di Vice Chancellor of UNIABUJA, Prof Abdul-Rasheed Na’Allah, advise all di presidential candidates make dem come tell Nigerians about why they want rule di country.

He lament say despite di abundance of mineral resources for Nigeria, di country still dey battle with issues like electricity wey no stable, and a poor healthcare system while roads be death trapped.