fbpx
March 28, 2024

Abba kyari release account, give assets details

0

Deputy commissioner of police wey dem stop from working Abba kyari don talk for Monday sey all di things wey National Drug Law Enforcement Agency talk about him sey na him get 14 assets , including shopping mall, residential estate, polo playground, lands and farmland sey all d things na lie lie sey no be him get am at all.

Kyari wey be former former Commander, Intelligence Response Team for one statement wey hin lawyer Hamza Dan Tani talk,hin sey di reports wey NDLEA give no true at all sey dey only wan spoil Kyari image with dat.

You Fit Like Read: Flood for Jigawa, Tinubu sympathize with di pipu wey e affect

He challenged di NDLEA sey make dem immediately release all hin account statements give di public if them know sey all di thing wey dem dey talk na true.

When hin dey share di details, Tani talk sey na only N2.8 million dey hin UBA account wey be sey na since eight years hin don dey use am, 7,000 pounds na hin dey GTB wey hin don keep over eight years ago, another N350,000 dey GTB bank too.

Others be N200,000 for Sterling Bank and hin Access Bank Account no dey in use for over eight years.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *