fbpx
March 28, 2024

Dem don dey carry politics go far:APC, PDP, Others no even mourn Ogun guber candidate, Bamgbose wey Peme

0

E don reach four days now wey governorship candidate for di Peoples Redemption Party (PRP) in Ogun State, Professor David Bamgbose waka go meet baba God for heaven but all di Odogwu Politicians no gree mourn di soul wey just change address.

Wetin Tori pipu gather be sey, Bamgbose na diabetes patient sey e fit be sey na as hin case worse on top sey hin no get time for himself because of di 2023 election na hin make him die.

YOU FIT LIKE READ: E Be Like Say I Go Die Young- Femi Kuti

Bamgbose death shock everybodi wey dey ogun because many pipu still hear hin voice radio on top few days
before dem announce am sey hin don die.

Dem talk sey apart from di Chairman of di New Nigeria Peoples Party (NNPP), Olaposi Oginni,wey don show sympathy for di death of di Professor, Other politicians never show face. READ MORE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *