fbpx
April 23, 2024

Flood for Jigawa, Tinubu sympathize with di pipu wey e affect

0
Governor\Badaru

Presidential candidate of the All Progressives Congress (APC), Asiwaju Bola Ahmed Tinubu, on  Saturday, follow mourn the death of 51 people pipu wey kpai for di recent flood wey happen for Jigawa State.

Many communities wey dey di state suffer wetin di flood cause, Up to four local governments suffer well well because of how the flood take touch dem. Di flood bad so tey e make some pipu no get house to stay again.

You fit like to read: FG to distribute N130m grant to 6,511 in Katsina.

Tinubu for one statement on Saturday wia media carry for hin office talk say di thing wey happen no sweet person for bodi , e dey very sad.

For di letter wey hin write to Jigawa State Governor, Alhaji Abubakar Badaru, the former Lagos State governor, hin  hope for fast recovery for all the pipu wey wound because of the flood.

Tinubu encourage everybodi say make dem stay strong even for di face of di challenge wey dem dey face.

 You fit go see more of wetin happen for di tori, CLICK HERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *