fbpx
April 28, 2024

Portable buy new Lexus worth over 30 million naira after one door close.

portable-brand-new-2021-lexus

Portable, wey be popular singer and heavyweight champion, don add brand new 2021 Lexus RX350 premium edition join di many cars wey dey hin garage. Dis one happen few months afta hin G Wagon spoil.

Di singer show off di new whip for him Instagram page as e celebrate di new purchase. E share foto of di inside of di new Lexus as e thank God for di blessing.

Portable yan say: “IFA Olumope, as one door close, three more go open. Aje Olokun.”

 

FOR MORE NEWS: “I tell Yul Edochie say I see danger for hin pikin before e die”- Prophetess yan another warning

 

Some pipo react to di news:

that_lekki_carguy talk say: “E look like 2020 RX 350 to me, I dey see 50 million naira! Abeg ooo, even Range Rover Velar 2020 model no reach 50 million naira, and of course you sabi say di vibes different. Velar e pass am… But I dey justify say di blogger dey right, e just dey slightly above dat price for di new one, fit dey around 30.8_9 million naira, depend on di dealer… Congratulations Portable ❤️❤️❤️❤️”

iamstempee write: “Akoi grace ika of Africa plus another wife loading new wife 😂”

yinksbodurin yan say: “If e na 2020, e no fit less dan 40m but truly e be 2020, but if e na 2016 to 2018 e fit be 35m baba nla big congrats”

uncleramsey yan say: “Abeg make e no get accident abeg🙏🏽

You fit go read di tori of Portable brand new 2021 Lexus…READ MORE