fbpx
May 4, 2024

Senator Abiru congratulate Tinubu on Tribunal victory

abiru-congratulate-president-tinubu

Sen. Tokunbo Abiru (Lagos-East) don congratulate President Bola Tinubu, on hin Wednesday victory for di Presidential Election Petition Tribunal.

Abiru compliment Tinubu inside statement wey hin media aide, Mr Enitan Olukotun, issue for Lagos on Thursday.

Di lawmaker hail di confirmation of Tinubu mandate, and hin describe di tribunal verdict as di true reflection of di will of di pipo.

Also, Abiru congratulate members and supporters of di All Progressives Congress, APC, and millions of Nigerians wey voted for Tinubu on Feb. 25.

Abiru, di Chairman of di Senate Committee on Banking, Insurance and other Financial Institutions, express confidence say di president no fail hin promise to renew Nigerians’ hope.

 

FOR MORE NEWS: Presidential election judgment: Let peace reign – CAN advise Nigerians

 

Also, as Abiru congratulate President Tinubu, hin advise Nigerians across political, religious and ethnic divides make dem support di Bola Tinubu administration for better Nigeria.

Also, for inside dat statement, hin rejoice with di President of di Federal Republic of Nigeria, Asiwaju Bola Tinubu, on di landmark victory.

According to am, di tribunal don re-echoe di will of Nigerians through dia verdict, and na well-deserved victory.

In addition, Abiru tok say Regardless of our various political leanings, we need to put di past behind us and make we dey involved in di nation-building task.

You fit go read di tori…READ MORE