fbpx
May 5, 2024

Presidential election judgment: Let peace reign – CAN advise Nigerians

can-chairman-call-on-nigerians

Di Kaduna State Chairman of di Christian Association of Nigeria, CAN, Rev John Joseph Hayab don call on Nigerians say make peace reign, and make dem allow di rule of law take hin course for di judgement of di presidential election petition tribunal.

As hin dey tok to newsmen for Kaduna, di CAN Chairman yarn say make we Nigerians, respect di judicial system for di interest of peace and harmonious coexistence of di kontri.

Hin yarn say make Nigerians no become wetin go divide di country based on political differences, but unite and work with di person wey di court rule favour.

Also, hin tok say Politicians go come and go but di kontri go remain. Na dis reason hin tok say Nigerians must think inward and make dem no allow some selfish individuals put di kontri for confusion.

 

FOR MORE NEWS: President Election Court: Atiku, Obi still dey fight, Tinubu, and others hail judgement

 

Hayab advise politicians and all Nigerians make dem accept di judgement of di tribunal.

Since di tribunal don make her pronouncement, hin tok say make pipo keep politics aside for our kontri to move forward.

In addition, hin yarn say window to appeal di judgement dey, and those pipo wey challenge di election results need for follow dat avenue instead of violent approach wey fit lead to chaos, loss of lives, and destruction of property. Na di advise wey hin give be dat.

As CAN chairman call on Nigerians, hin advise politicians make dem recognize di spirit of sportsmanship where winner and loser go always dey.

You fit go read di tori…READ MORE