fbpx
May 5, 2024

Gabon President, Ali Bongo No Dey House Arrest Again – Junta

bongo-fit-travel-abroad

Inside statement wey dem deliver on national television on Wednesday evening, Gabon military spokesperson Colonel Ulrich Manfoumbi yarn say di former president, Bongo fit “travel abroad for medical checkups” because of hin condition.

Bongo don dey under house arrest since di kontri military coup on August 30. Some pipo expel hin regime shortly after hin bin dey declared as di winner of contentious elections wey for extend hin 14-year presidency.

Given his state of health, the former President of the Republic Ali Bongo Ondimba is free to move about. He may, if he wishes, travel abroad for medical checkups,” Na wetin Manfoumbi tok be dat.

 

FOR MORE NEWS: I dey kampe – Actor Tony Umez Debunk Death Rumours

 

Di statement wey announce Bongo release from house arrest bin dey signed by General Brice Clotaire Oligui Nguema, Gabon new president, wey dem swear in Monday.

Oligui, Bongo cousin, before na bodyguard for Bongo late papa and also, hin lead di kontri republican guard, an elite military unit.

As e be so, Bongo get di choice to comot for di nation, hin fit travel abroad according to AlJazeera’s Nicolas Haque, reporting from Dakar, Senegal.

According to Haque, Bongo bin get stroke five years ago and hin bin no get access to hin own doctors.

You fit go read di tori…READ MORE