fbpx
April 26, 2024

“I married a woman in whom I am well pleased” – Actor Artus Frank Tell Pipo wey dey Age-Shame Hin Wife

actor-artus-frank-warn-critics

Nollywood actor, Artus Frank don warn critics wey dey age-shame hin wife.

Inside post wey Artus Frank share to warn critics on top hin IG page last night, Frank tok say hin no marry age and say hin marry woman wey hin dey well pleased with. Also, hin ask pipo make dem comot hin wife name from dia mouths.

Remember say Uche Ogbodo, wey don marry upcoming singer, Bobby Marris, follow give warning to pipo wey dey shame her for marrying younger man.

Di couple wey dey very much in love show off dia relationship on top social media despite dia age differences. However, Uche dey always collect bad mouth from pipo because she date man wey young pass her.

FOR MORE NEWS: Sanwo-Olu list Spyro ‘Who’s Your Guy’ as hin current favorite song

Taking to her Instagram page, Uche wey don dey swallow all di bad mouth finally slam pipo wey dey bad mouth her. She lament say dem dey always call her old woman because of her relationship. Also, she ask di pipo wey dey shame her weda dia papoa no follow love older women.

She wrote: Small thing old woman old woman! You marry small boy, you marry small boy! Unah popsy no be older women him dey like? Even ones wey old pass me! abeg shut the fuxck up.

As she Caption her post, Uche warn her critics make dem stop dat act because di goddess wey dey her body na violent being.

“I am a peaceful person I no dey like trouble, but stop waking up the goddess, she is a vawulent being”

You fit go read di tori…READ MORE