fbpx
April 19, 2024

Sanwo-Olu list Spyro ‘Who’s Your Guy’ as hin current favorite song

sanwo-olu-share-hin-favourite-song

Sanwo-Olu musical taste dey well-received by Spyro fans wey don express dia excitement and support for di artist on top social media.

However, some individuals no care about di Governor choice of music, as dem still no dey satisfied with di outcome of di just-concluded elections and how e favor Sanwo-Olu.

After di gubernatorial election on March 18, 2023, di incumbent bin dey re-elected as governor of di state. He receive a total of 762,134 votes.

FOR MORE NEWS: 2023 AFCONQ: NFF don announce gate fees for Super Eagles, Guinea-Bissau clash

Also, dis na as hin beat di Labour Party (LP) Gbadebo Rhodes-Vivour and di People’s Democratic Party (PDP) Abdul-Azeez Adediran aka Jandor, wey receive 312,329 and 62,449 votes, respectively.

Inside recent video wey di Senior Special Assistant (SSA) to di Governor of Lagos State on New Media, Jubril Gawat post for Twitter, Sanwo-Olu dey sit down for hin office share hin favorite song. For di video,  person ask am which song be hin favorite song. Hin answer say na Spiro “Who’s your guy” be hin favorite.

 “Right now is, ‘Who’s Your Guy’ by Spyro. Oh yes, I’m following up with my pipo. I love the song, yes!”

You fit go read di tori…READ MORE