fbpx
May 18, 2024

Popular actor Don Brymo don kpai, cause of death revealed

actor-don-brymo-don-kpai

Actor Don Brymo don kpai. Di cause of death of popular Nollywood actor, Don Brymo Uchegbu, don come out after di actor unfortunately pass on.

According to sources, Brymo bin no well while and e dey sad say hin kpai dis morning. Pipo claim say di actor suddenly collapse during movie shoot.

Plenty pipo sabi di actor for hin remarkable performances for different Nollywood movies. Hin na talented actor wey get passion for hin craft.

Hin death come as a shock to plenty pipo for film industry and hin fans.

Social media dey flooded with messages of condolence from fans and colleagues wey express dia sadness over di loss of dat kain talented actor.

 

FOR MORE NEWS: “Odogwu Don Turn to Vegetable” – Late Don Brymo Uchegbu Final Words Revealed

 

throwbacknaijatvv yarn say hin collapse inside hin Hotel Room somewhere for Ohada where dem go shoot movie, na for there dem Rush am go Hospital and doctor tok say na Partial Stroke and sugar level, after some treatment dem decided to carry am go back to Anambra State and hin kon kpai Few hours after dem reach Anambra.

feminine.healthcare write: “Hin don sign out of dia world. All of us go sign out one day, but nobody know when or how e go happen. May God Almighty help us not to die an untimely death in Jesus name.”

iam.chioma_ say: “It’s a lie, Someone I just watched his video with Mr.Harrry B yesterday??”

zarq_02 commented: “Nigerian tallest man don kpai too.”

pocopills reacted: “I was with him yesterday ! We ate together sir pls wake up.”

Actor Don Brymo don kpai, you fit go read di tori…READ MORE