fbpx
May 14, 2024

LGBTQI: Outrage as US wan train Nigerian agencies on gay rights

outrage-as-us-wan-train-nigerians-on-gay-rights-

Di United States Embassy wey train Nigerians on how to respect and protect di human rights of LGBTQI+ persons don spark outrage.

LGBTQI na di acronym for lesbian, gay, bisexual, transgender, queer and intersex.

On Tuesday, di U.S. Mission announce say dem fund 4-day “train-the-trainers awareness workshop” for Nigerian law enforcement officers and other relevant agencies.

Di information wey dem send for Twitter no go well with social media users. This matter make dem start to accuse America of disrespecting Nigerian laws.

“Wetin be di essence of this training when di laws of di land no approve LGBTQI,” @Suleaaron na hin reply this one.

“Your politics of lack of respect for di African nations and di Chinese politics dey very clear to di world. E be like di difference between good and evil”, @IsZhrdn tok this one with anger.

Dem dey vex say why US go train Nigerian for that kain thing.

FOR MORE NEWS: 7 pipo don kpai after di shootings for California farms, di suspect dey custody

“Legislation dey wey forbid am, it, di State Department still go fund campaign on di issue because the US embassy no dey always respect di beliefs and laws of dia host countries,” @MusaYakubuMust tweet this one.

“Why you no kuku spend funds to train officers make dem know how to handle voters during general elections 2023. This na Diverse Nigeria with many cultures and traditions. We need get our leadership right first before other thing,” @jcpruzo na hin tok this.

For  January 2014, former President Goodluck bin sign bill wey criminalise same-sex relationships, a nd e shun western pressure over gay rights.

“Pipo wey enter into same-sex marriage contract or civil union, dey commit offence and dem dey liable on conviction to a term of 14 years in prison,” na w etin di bill stok be that.

Although, U.S. government bin condemn di legalisation through strong statement wey secretary of State, John Kerry issue.

“Apart from di ban on same sex marriage, di law restricts freedom of assembly … and expression for all Nigerians.” Na wetin hin tok for di statement.

Jerry add say di law no dey consistent with Nigeria international legal obligations, and e no go well with di democratic reforms and human rights protections.

Also, for October 2019, Jonathan open up say di U.S. and di U.K. bin stand against am because hin sign di Anti-Same sex Marriage Bill into law.

Di matter of US wey wan train Nigerians neva finish o.

You fit go read di full tori…READ MORE