fbpx
April 25, 2024

Adamu Garba don talk the reason why APC no need to look ‘Obidients’ with pikin eyes.

0
Adamu-Garba-

As 2023 general elections dey come, ex-presidential aspirant of the Young Progressives Party, YPP,wey be member of the All Progressive Congress now, APC, Adamu Garba, don warn hin party make dem no use small eyes look the supporters of Peter Obi, wey dey known as the ‘Obidient.’

Hin give this warning as tweet for hin verified Twitter handle.

Hin use Lesotho experience warn dem, as the party Presidency win because of young people votes.  Garba yarn say make dem look Obidients with small pikin eyes.

YOU STILL FIT ENJOY: Peter Obi no go win South-West – Dele Momodu

Garba even advise APC make dem get current strategic campaign if they wan win.

Na wetin hin write be this: “A party, RFP, founded by Sam in March 2022 in Lesotho, won the Presidency as a result of young people’s votes. A similar case happened in Kenya & Zambia, all in 2022. “That is why we shouldn’t underestimate these obidients
APC must have a modern strategic campaign to secure victory”.

You fit CLICK HERE go read more of this tori for Daily Post.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *