fbpx
May 3, 2024

Adeleke congratulate Tinubu on Supreme Court victory

adeleke-congratulate-president-tinubu

Governor Ademola Adeleke don congratulate President Bola Tinubu on di confirmation of hin election by di Supreme Court, and hin yarn say time don come for Nigeria to unite.

Based on di tori wey come out before, di apex court on Thursday bin dismiss di appeals of di Peoples Democratic Party (PDP), Labour Party (LP), and dia presidential candidates for di last election, Alhaji Atiku Abubakar and Mr Peter Obi.

Di two of dem bin go challenge di victory of President Bola Tinubu for di February 25 poll and dem bin dey find way to overturn di declaration of di Independent National Electoral Commission (INEC).

However, di Supreme Court don dismiss di appeal, and dem tok say new evidence no fit dey introduced for dat stage of appeal.

Inside congratulatory message issued by hin spokesperson, Mallam Olawale Rasheed, for Osogbo, Adeleke yarn say “Our judicial system again don prove say dem fit tackle matter wey arise from our elections”.

 

FOR MORE NEWS: Gaza War Fit Cause Global Famine, Varsity Professor Caution

 

Adeleke, wey note di finality of apex court ruling on disputes for di 2023 presidential election, yarn say di resolution of di questions wey surround di election go bring focus for di challenges wey Nigeria dey face.

Also, hin commend di main opposition candidate for di election as dem go deepen into di kontri electoral jurisprudence by testing dia complaints for di court of law.

On behalf of di good pipo of Osun State, Adeleke congratulate President Tinubu on hin judicial victory for di apex court.

According to wetin hin tok, hin hope say Tinubu administration go bring peace, unity an prosperity to di kontri. Also, hin restate hin commitment to partner with Tinubu by offering good governance for di pipo.

You fit go read di tori, Adeleke congratulate President Tinubu…READ MORE