fbpx
May 4, 2024

Bayelsa guber: INEC don delete Sylva name from candidates’ list

inec-delete-candidates-names

Di Independent National Electoral Commission, INEC, don delete di names of Timipre Sylva and hin running mate, Joshua Maciver, of di All Progressives Congress (APC) from di list of candidates for di forthcoming Bayelsa State gubernatorial election.

INEC on Tuesday release di amended lists of candidates for Bayelsa and Imo States governorship elections and dem upload di same for di commission website.

Also, di list dey signed by di Secretary to di Commission, Rose Oriaran-Anthony.

Di News Agency of Nigeria report say di column for di names of di APC candidate and hin running mate bin dey blank with “court order” remarks.

 

FOR MORE NEWS: Bishop Oyedepo pikin Isaac don dump Living Faith, to start new church

 

Also, di Secretary, Oriaran-Anthony, inside di amended document, explain say di commission action dey in obedience to court orders on di lists wey dem serve on di commission.

She state am say di commission publish di final list of candidates for di 2023 Bayelsa State Governorship Election on June 9 following di provision of Section 32 of di Electoral Act, 2022,  di timetable and schedule of activities for di election.

However, she still tok am say di commission collect court order regarding di nomination of di APC candidate for di Bayelsa State governorship election.

You fit go read di tori see more of why INEC delete those candidates names…READ MORE