fbpx
April 25, 2024

Again, EFCC don arrest Ogun Assembly Speaker, Clerk, Accountant

0
EFCC

Na di second time inside four days di operatives of the Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) don arrest di Speaker of the Ogun state House of Assembly, Olakunle Oluomo, for alleged fraudulent activities.

Di report wey dem carry be say di operatives bin don come arrest Mr Olumo on Thursday around 9:00 a.m. for di Murtala Mohammed International Airport in Lagos.

YOU FIT STILL ENJOY: EFCC Don Carry Ogun Speaker For Airport

Dem bin later release di speaker for late Friday night but dem tell am make hin come on Monday.

When the speaker go meet  EFCC for dia office on Monday, Dem detain am.

Some information wey come out tok say Mr Oluomo and two other suspects bin dey for inside EFCC custody around 9:43 p.m.

The speaker and hin media aide, Abdulgafar Adeleye, no gree answer phone calls of people wey want make hin tok something.

Wilson Uwujaren, the EFCC spokesperson, follow no tok anything, e no answer di phone calls too.

On Monday, the anti-graft agency filed an 11 count charge against Mr Oluomo and the Clerk of the House, Adedeji Adeyemo, and the Accountant, Oludayo Samuel.

You fit CLICK HERE go read more of wetin dey happen for the tori.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *