fbpx
April 18, 2024

EFCC Don Carry Ogun Speaker For Airport

0

Join body wey dem dey call Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) don carry Speaker of the Ogun State House of Assembly, Olakunle Oluomo for Muritala Muhammad Airport wey dey for Lagos State.

Na on Thursday tori peoole talk sey dem carry Oluomo on top money magomago.

YOU GO LIKE READ2023: Tinubu go get plenty Igbo votes, to continue Buhari beta work – Nwoye

Na one person wey dey work for di house of Assembly yarn tori pipu sey na di information wey pipu give EFCC na hin make dem hammer Oluomo for the Airport.

Tori wey tori pipu gather show sey Oluomo don dey wanted list of EFCC tey tey on top sey him and some other pipu dey forge signature and dey change some financial documents.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *