fbpx
May 14, 2024

‘Na abuse of court’, Tinubu oppose live broadcast of election petition proceedings

tinubu-oppose-live-broadcast

Di President-elect Bola Tinubu don oppose di application by hin closest rival, Atiku Abubakar and di Peoples Democratic Party (PDP) for live broadcast of di proceedings of di election petition.

In response to di application, Tinubu and hin vice, Kashim Shettima, through di team of dia lawyers led by Chief Wole Olanipekun yarn ay di application na “abuse of di processes of dis honourable court.”

 

FOR MORE NEWS: U-20 World Cup: Flying Eagles battle dey ready for all opponents – Bosso

 

Dem appeal di Presidential Election Petition Court say make dem dismiss di application. Also, dem argue say di relief wey di applicants want no be wetin di court fit grant it.

Di respondents yarn say “with much respect to di petitioners, di motion na abuse of di processes of di honourable court.”

In addition, dem yarn say make court ignore Atiku request because di courno be rostrum or soapbox. No be stadium or theatre. And, no be arena for ‘public’ entertainment.”

You fit go read di tori as Tinubu oppose live broadcast of election petition  proceedings…READ MORE