fbpx
May 5, 2024

Akpabio hail Tinubu over Visa Crisis resolution

akpabio-hail-tinubu-on-visa-resolution

Di President of di Senate,  Senator  Godswill Akpabio,  don hail  President Bola Tinubu for wetin hin call,  hin creativity and proactiveness to resolve di visa crisis with di United Arab Emirate.

Akpabio wey describe di action as socio-political showpiece, yarn say di President na genius as hin restore diplomatic relations between Nigeria and UAE without stress, considering di economic loss of di two nation during di period of di unfortunate disagreement.

Inside statement wey come out yesterday for Abuja by hin Special Adviser on Media and Publicity,  Hon. Eseme Eyiboh, di President  of di Senate toksay with di peaceful resolution of di face-off, di two nations dey on track to reap bountifully from dia connections.

 

FOR MORE NEWS: Rema and Selena Gomez win di first-ever Best Afrobeats VMAs award

 

Also, Akpabio wey comment say hin happy about di development explain say na strategic move wey go reinvent and strengthen consular and economic ties between Nigeria and di UAE.

However, hin assure President Tinubu say di National Assembly under hin leadership go continue to provide di required legal framework so dat di executive go implement di good policies wey dey inside di Renewed Hope Agenda blueprint.

You fit go read di tori see as Akpabio hail Tinubu…READ MORE