fbpx
May 4, 2024

Shettima go represent Tinubu for G77 summit for Cuba

shettima-go-represent-tinubu-for-cuba

Vice president Kashim Shettima on Wednesday comot for Nigeria to represent President Bola Tinubu for di G77+China Leaders’ Summit for Havana, Cuba, wey go hold from Sept. 15 to 17.

Di Director of Information, Office of di Vice President, Mr Olusola Abiola, inside statement, yarn say Shettima go join other world leaders, including di UN Secretary-General, Antonio Gutteres, for di Summit.

Hin tok say di summit go tok about di development issues wey members, mostly from di global south dey face.

 

FOR MORE MORE: Akpabio hail Tinubu over Visa Crisis resolution

 

Also, hin tok say di summit go explore proactive ways of addressing challenges facing di development of di member-states leveraging science, technology and innovation to enhance socio-economic growth.

Abiola yarn say na President of di Republic of Cuba, Miguel Díaz-Canel, go host di Havana Summit for hin capacity as Chairman of di G77.

Di theme of di summit na “Current Development Challenges: The Role of Science, Technology and Innovation.

Shettima go represent Tinubu for Cuba, You fit go read di tori…READ MORE