fbpx
May 5, 2024

UAE don lift visa ban on Nigeria as Emirates, Etihad airlines resume flight operations

uae-lift-visa-ban-on-nigeria

Di United Arab Emirates, UAE, yesterday lift di visa ban wey dem place on Nigeria after meeting between President Bola Tinubu and hin UAE counterpart, Mohamed bin Zayed Al Nahyan, for Abu Dhabi.

Another landmark agreement for di meeting between di two leaders na di immediate resumption of flight schedules of both Etihad Airlines and Emirates Airlines in and out of Nigeria without any further delay.

You fit remember say di two airlines bin suspend dia operations for di kontri due to dia inability of remit home millions of dollars wey dem earn from dia operations, and na because of forex problems for di kontri.

Inside statement issued by di Special Adviser to President Tinubu on Media and Publicity, Ajuri Ngelale na hin dem make di agreement known.

 

FOR MORE NEWS: PDP Chairman don resign for Kogi

 

Di statement read say just as di negotiation go between di two heads of state, dis immediate restoration of flight activity through these two airlines and between di two kontries no involve any immediate payment by di Nigerian government.

Additionally, President Tinubu dey happy as hin don successfully negotiate a joint, new foreign exchange liquidity programme between di two governments, wey dem go announced in detail for di coming weeks.

Also, di President wish to commend di UAE President, Mohamed bin Zayed Al Nahyan, for hin friendship and determined effort to join hands with am to fully normalize and reset to excellence di standard of relations between di two kontries.

UAE lift visa ban on Nigeria, You fit go read di tori…READ MORE