fbpx
May 6, 2024

Tinubu don crash expectations of Nigerians – APC ex-NWC member

APC-ex-NWC-member-raise-alarm-over-disturbing-signals

Di immediate-past National Vice Chairman, Northwest, of di ruling All Progressives Congress APC, Salihu Moh. Lukman don raise alarm over wetin hin tag as “disturbing signals” under di developing administration of President Bola Tinubu.

Also, dis na as Lukman accuse di president of crashing di earnest expectations of Nigerians wey don hope say hin go come up with crack squad instead of di the lacklustre ministerial nominations wey hin forward to di Senate.

Inside open letter to di president on Monday, Lukman yarn say hin decide to make di letter open “because as hin resign hin position as member of di APC National Working Committee NWC, hin no wan make any claim of having access to di president in whatever form.

 

FOR MORE NEWS: Bobrisky papa Mr Kunle Okuneye don kpai

 

Even as NWC member, hin tok say e no easy to access di President after hin winning di election.

Now, from di time wey hin resign, hin disagree with di president decision to nominate Dr. Abdullahi Umar Ganduje to emerge as di National Chairman of APC.

In addition, hin yarn say if di president no stop di disturbing signals, dat one fit produce bigger problems and irreversibly destroy APC electoral viability as a party.

You fit go read di tori see di alarm wey Lukman raise over disturbing signals…READ MORE