fbpx
May 7, 2024

Tribunal: Atiku and Peter Obi petitions against Tinubu dey hopeless – APC Secretary, Basiru

Di-petitions-dey-hopeless-APC-secretary-Basiru

Di National Secretary of di ruling All Progressives Congress, APC, Senator Ajibola Basiru describe di petitions wey dey challenge victory of President Bola Tinubu for di 2023 presidential election as “terribly hopeless.”

Basiru yarn dis one when hin dey tok during interview with Channels Television on Sunday.

Remember say Atiku Abubakar of di Peoples Democratic Party, PDP, and Peter Obi of di Labour Party, LP, dey challenge Tinubu victory for court.

But, di APC national secretary dismiss di case of PDP and Labour Party presidential candidates.

 

FOR MORE NEWS: Tinubu don crash expectations of Nigerians – APC ex-NWC member

 

Also, Basiru dismiss speculations wey tok say di ruling party dey prepare to rerun election.

Hin yarn say from hin knowledge of electoral law for Nigeria and to read the petitions and also as hin dey part of di proceedings, hin go yarn say all petitions against President Bola Ahmed Tinubu election dey hopeless and nobody need to even waste time to dismiss di same thing.

“They are hopeless petitions, terribly hopeless,” Na wetin hin add be dat.

You fit go read di tori…READ MORE