fbpx
March 29, 2024

Alleged diversion of funds: ICPC don finally release D’banj

0
D'banj-

Di Independent Corrupt Practices Commission (ICPC) on Friday don free Oladapo Oyebanjo. Hin dey known by hin stage name D’banj, dem arrest and detain over di alleged diversion of N-Power funds.

Di popular singer wey dem arrest on Wednesday dey accused of planning with some politicians and banks to divert di fund.

According to Vanguard, dem release di singer on Friday after three days of detention for di custody of di commission as di investigation continues.

As dem release di singer, dem talk say dem go call am later for further investigations.

Remember say D’banj lawyer, Pelumi Olajengbesi bin demand for di release of hin client for one statement. , Hin ask di National Assembly make dem put mouth for di matter by investigating di allegations against Dbanj.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *