fbpx
April 20, 2024

My marriage crash base on say my wife tok say she don tire – Julius Agwu

0

Nigerian stand-up comedian Julius Agwu don confirm di crash of marriage beetwin him and hin wife, Ibiere.

For one interview with media personality Daddy Freeze, di 49-year-old tok say hin wife tok say she don tire of di marriage na di reason why she leave.

U FIT ALSO READ Man declared missing after hin attend programme for Redemption Camp

Julius tok say despite say hin marriage fail, hin tok say him bin dey happy, after hin wife leave am.

Hin tok say hin give thanks to almighty God say him dey alive, despite say Satan dey work in mysterious ways, God still dey work in miraculous ways for hin life.”

Speaking more about hin health issue, Julius admit di rumour about health failure hin tok say na true.

Hin tok say for 2016, dem bin admit am for one hospital like dat for London, where him bin dey for coma for three months.

Julius tok say him bin get brain tumour for 2015. When hin travel to London to do one show, just two days bifore the show, dem rush am to hospital.for 3 months hin bin dey for coma. But hin thank God say him still dey alive.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *