fbpx
May 25, 2024

Gen Z don pepper Angel” – Reactions as Angel pack her bag, plans for voluntary exit

angel-want-voluntary-exit-from-BBNaja-House

Camera capture Big Brother Naija housemate Angel Smith as she dey packs her bags dey plan to comot for di house by herself when nobody send her comot, she want voluntary exit.

Dis decision by Angel come after she do physical fight with her fellow housemate Ilebaye last night after dia Guinness Task.

Di drama between di two women start when Ilebaye decide to remove her nail paint as she stand on top Angel clothing box. Dis one na just after she use restroom finish.

 

FOR MORE NEWS: Lagos Plane Crash: Investigators dey ask Pilots question

 

Ilebaye tell her say she suppose close di box when Angel ask her why she put her legs on top am.

Dis matter make Angel vex, and di confrontation turn to fight as di two of dem kon start to dey abuse dia sef.

Following di fight with Ilebaye, Angel bin dey inside dressing room dey pack her bags as she claim say she want voluntary exit from di Big Brother Naija house.

Mercy Eke, wey be fellow housemate bin dey beg her say make she no go. Also she bin dey try convince her say make she no exit di house.

You fit go read di tori…READ MORE