fbpx
May 19, 2024

Angry Mob Beat Robbery Suspect To Death For Lagos

angry-mob-beat-robbery-suspect

One suspected robber with toy gun don collect serious beating from angry mob for Lagos State, di angry mob beat di robbery suspect to death.

Di pipo wey dey dat area grab di suspect wey dey identified as Victor, dis na as hin bin dey make attempts to rob one resident of Olugboso for Agege area of Lagos.

Also, na di Police Public Relations Officer, PPRO, SP Benjamin Hundeyin na hin confirm di incident on Sunday.

According to how di tori take come out, some gang catch di suspect wey bin wan rob person for hin house.

 

FOR MORE NEWS: Art minister, Musawa deny statement on NYSC status

 

Di Angry mob wey beat di robbery suspect bin catch am with toy gun wey hin bin dey use threaten hin victims.

Confirming di development, di Lagos PPRO yarn say di suspect corpse dey for mortuary already, while Victor, wey confront di suspect dey respond to treatment for hospital.

Di police yarn say as di incident happen, dem see pair of scissors and toy gun with di suspect. Also, dem still dey Investigate di matter.

You fit go read di tori…READ MORE