fbpx
December 23, 2024

“Something wey dey sweet like sugar” – Actress Anita Joseph reply pipo wey say marriage na scam, she share tips

anita-joseph-drop-marriage-advice-for-pipo

Nollywood actress, Anita Joseph, don address pipo wey believe say marriage na scam for our world today, she drop some marriage advice.

Taking to her Instagram page, di happily married thespian, wey dey married to event host MC Fish, yarn say marriages wey dey work still dey and say marriage na beautiful thing.

As she share video of herself and her husband when dem dey enjoy dia self and dem dey enjoy good time together, di actress drop some tips on how to make marriage work.

She encourage women make dem dey submissive and respectful to dia husbands and advise men say make dem take responsibility.

 

FOR MORE NEWS: Shey na true? Tinubu return Nigeria with “charging port” – Charly Boy dey ask

“When you marry a bombastic element, you say marriage is a scam. There are marriages that are sweet like sugar. It is a union that God himself ordained. Women should be submissive and respectful, but please don’t take buckets of nonsense. Men should take responsibility and stop embarrassing their wives. You are not the only one in the marriage. I miss my village Dubai,” Na wetin she write be dat.

E dey clear say Anita believe in di institution of marriage and saye fit dey successful with di right attitude and effort. While some fit hold di opinion say marriage is a scam, e dey important to know say plenty successful marriages dey, and e take two committed partners to make am work.

You fit go read di tori see Anita Joseph marriage advice…READ MORE