fbpx
April 26, 2024

Singapore hang man over conspiracy to supply cannabis

singapore-hang-man

Singapore don hang one man because hin plan to traffic cannabis despite di appeals for clemency from hin family, activists and di United Nations.

According to BBC, Singapore hang Tangaraju Suppiah, di 46-year-old man early morning on Wednesday over plan to smuggle 1kg (35oz) of cannabis.

Activists claim say Suppiah bin dey convicted on weak evidence and hin receive limited legal access during hin prosecution.

But Singapore authorities yarn say na fair trial dem give am and dem criticise di pipo wey dey question di courts.

 

FOR MORE NEWS: Shey na true? Tinubu return Nigeria with “charging port” – Charly Boy dey ask

 

Singapore get some of di world toughest anti-drug laws. And dem claim say hin execution na necessary action to drug crime wey don become major issue elsewhere across South-East Asia.

On Wednesday, Suppiah family gather for Changi Prison near di city airport for di east to receive hin body.

Also, di family tok say dey no go give up on am right until to the end,” anti-death penalty activist Kirsten Han na hin tell BBC dis one.

Last year Singapore hang 11 pipo, all of dem on drugs charges – including an intellectually impaired man wey dey convicted of trafficking three tablespoons of heroin.

You fit go read di tori…READ MORE