fbpx
May 15, 2024

Appeal Court don grant Senator Akpan bail

Di Court of Appeal wey dey for Port Harcourt, di Rivers State capital, don grant bail to Uyo Senatorial District Senator, Bassey Albert Akpan.

Di court grant Akpan bail base on health grounds pending di determination of an appeal.

U FIT ALSO READ FG to make pronouncement on salary increment — Chris Ngige

On December 1, 2022, Uyo Federal High Court-led by Justice A.A. Okeke bin sentence di Senator to 42 years imprisonment ontop corruption mata.

Di Economic and Financial Crimes Commission, EFCC, charge Albert for receiving expensive cars worth of N204m from one contractor of di Akwa Ibom State Government, Jide Omokare.

Reacting to di bail after di court grant Albert, hin tok say ‘give thanks to God’

Hin yarn dis one inside one of hin Facebook post, di governorship candidate of di Young Progressives Party, YPP, write say: “In every situation, God has something to say. It’s all about God. That same God.”

To read di full tori CLICKHERE