fbpx
May 4, 2024

ASUU – Femi Gbajabiamila run ASUU Street to call off strike

ASUU: Femi Gbajabiamila run ASUU Street to call off strike

ASUU: The Academic Staff Union of Universities (ASUU) don has accuse the Speaker of the House of Representatives, Femi Gbajabiamila, lie lie promise so that the union go call off its eight-month-old strike for October as he give us written promise for paper say government go do everything wey dem promise without delay. As matter dey go now so we don see say Femi only run ASUU Street just to call off the strike.

Other news you go like read: 2023: Endorse di “Devil” you know, Shehu Sani tell Wike and hin G5 led govs

Nah wetin ASUU President of the union, Prof Emmanuel Osodeke, yarn be dis during one exclusive interview on Tuesday as he dey talk consigning how things be now with the Federal government on top wetin dem promise to call off the strike.

ASUU Presido talk say ASUU get soft spot for the speaker, that be the reason dem ready work with am when he put mouth for the matter wey dey ground between ASUU and federal government.

ASUU president talk say, No be just say he promise, he sign paper give us say Government go pay full eight month salary, settle controversy wey dey Universities Transparency and Accountability Solution (UTAS) and among others matter wey dey cause wahala everytime…

You go like read the full tori…..click the button wey dey here https://tribuneonlineng.com/gbajabiamila-deceived-us-to-call-off-strike-%e2%80%95-asuu/