fbpx
April 26, 2024

Aproko Doctor don share advice with women wey dey find BBL surgeries

aproko-doctor-advice-on-bbl

E neva too tey wey report yarn say one 20-year-old lady kpai after she go through di procedure.

According to di doctor wey dey always share tips on living a healthy life, di surgeries na risky procedures.

Aproko Doctor advise women say make dem always make sure say dia surgeons na qualified experts before undergoing di BBL surgery.

Na wetin hin write be dis, “If you want to have cosmetic surgery, make sure your surgeon is fully qualified. Yes, every surgical procedure comes with risks, especially BBLs. A lady just died here in Lagos following one of these surgeries. May she RIP. BBLs can be dangerous and carry a huge risk, so be aware.”

FOR MORE NEWS: Seyi Vibez mama don kpai

Dis matter dey come in di wake of di news say one young Nigerian lady, wey dey identified as Destiny, kpai as she undergo di cosmetic surgery for Lagos. She kpai because di procedure go wrong.

One friend of di deceased claim say Destiny undergo Brazilian buttlift operation for di aesthetic hospital for Lagos.

BBL (Brazilian Butt Lift) surgery don gain popularity for recent years, but na major surgical procedure wey carries risks and potential complications. Also, e dey important for anyone wey dey consider dis type of surgery make  dem do dia research and consult with a board-certified plastic surgeon.

You fit go read di full tori…READ MORE