fbpx
May 4, 2024

Tinubu start well as Nigeria President

tinubu-start-well-as-president

A former Deputy National Chairman of Peoples Democratic Party (PDP), Bode George yarn say President Bola Tinubu don start well as Nigeria President.

Chief George tok dis one inside interview on top Channels Television Politics Today on Tuesday.

According to am, di early days of Tinubu as di Nigerian leader no dey perfect, but reasonably better than hin time as di Lagos State governor between May 1999 and May 2007

However, di PDP chieftain, yarn say di President must manage di people and di kontri resources well.

Also, hin yarn say di major difference between Bola and himself na di methodology, hin managerial style, unlike hin own.

 

FOR MORE NEWS: BREAKING: Ex-Governor Ortom present himself to EFCC for Makurdi

 

In addition, hin tok say hin get background for di military and hin be logistician for di military. Hin tok say person no carry hin men go war without serious planning, intelligence gathering.”

As hin dey give assessment of di Tinubu administration for di last three weeks, George yarn say no be 100-metre race. Also, Tinubu need to manage hin pipo and to manage di resources of dis kontri for the betterment of dis country.

Di PDP stalwart tok say e no dey perfect but reasonable. At least, e better than wetin hin know before when hin dey Lagos. He tok say may dat time, Tinubu bin still dey young with no experience but now, Lagos no be Abuja.

You fit go read di tori as Bode yarn say Tinubu start well as Nigeria President….READ MORE