fbpx
May 16, 2024

Obasanjo don join advocacy for woman to lead Nigeria

obasanjo-join-call-for-female-president

Former President Olusegun Obasanjo on Thursday for Abeokuta join di call for female President for Nigeria.

Obasanjo tok dis matter for di Egba Dialect Debate and Choral Competition for Secondary Schools wey dey Ogun Central District.

He yarn say e no fair as women no dey join di nation topmost job despite dia contributions to society.

Di former Head of State tok say power and key positions must dey shared among both genders for fairness and equity.

 

FOR MORE NEWS: WAEC don arrest principals, supervisors, for malpractice

 

Obasanjo tell di audience say dem need to give di womenfolk chance to lead.

“A female can get pregnant for nine months, and a male can’t. That is the only difference between us.

“There is nothing preventing the female gender to be the president of our country,” Na wetin di retired General tok be dat.

Ogun Deputy Governor, Naimot Salako-Oyedele charge more women make dem join politics to claim dominance since dem get di numbers.

You fit go read di tori as Obasanjo join call for female President for Nigeria…READ MORE