fbpx
May 20, 2024

Argentina vs France: Messi don break another record for World Cup final

0
lionel-messi_

Argentina captain, Lionel Messi, on Sunday evening break another World Cup record after hin start di 2022 Qatar final between his team and France.

Remember say Messi bin don make hin 1,000th competitive appearance for di knockout stages for Qatar.

Di 35-year-old make hin 26th World Cup appearance for di final against France for di Lusail Stadium. Hin break di record wey Germany legend Lothar Matthaus bin dey hold for di most World Cup games by a male player.

FOR MORE NEWS: Mbappe sef don win Golden Boot ahead of Messi

Di Paris Saint-Germain forward equal and e beat di Argentina record – wey belong to di late Diego Maradona earlier for di  competition.

Di former Barcelona captain follow overtake Rafa Marquez to become di player with di most World Cup appearances as captain.

Hin long-time rival Cristiano Ronaldo no play reach di one wey hin play for di World Cup games.

You fit go read di full tori…READ MORE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *