fbpx
May 5, 2024

“I go like work with Kanye West” – Asake

asake-wan-collaborate-with-kanye-west

Ahmed Ololade, wey dey known as Asake,  Nigerian afrobeat singer, don tok say hin wan collaborate with billionaire American rapper Kanye West.

Inside interview with Billboard News, Asake reveal say hin don pray to God to make di cooperation possible.

Also, hin tok say hin prefer to collaborate with artists wey hin get relationships with.

Asake tok say hin need to like person first before hin fit make music with di person. Also, hin need to dey comfortable with dey before hin fit do anything with dem. Hin tok say no be because of music alone.

 

FOR MORE NEWS: Portable enter filling station pay everybody fuel money

 

However, according to wetin hin tok, no be say hin no fit make music with other people but hin like real energy.

In addition, hin yarn say e good if person like am beyond di music, But hin need to connect with dia music, and like di person wey hin wan work with first so dat e no go be problem for me. There must be synergy.

“I have been saying this thing since; maybe God will do it. I will like to work with Kanye [West].” Na wetin Asake tok be dat. Asake yarn say hin wan collaborate with Kanye West

You fit go read di tori…READ MORE