fbpx
May 5, 2024

Portable enter filling station pay everybody fuel money

portable-pay-for-pipo-fuel-as-hin-enter-filling-station

Nigerian singer Portable again don catch di attention of di internet, but dis time for a heartwarming reason as hin enter filling station, pay for pipo fuel, dat act bring joy to plenty pipo.

No be news again say portable dey always be topic of discussion for Nigerian internet. Also, e neva tey wey hin celebrate hin wedding anniversary for di streets of Lagos with hin wife.

Before dat time, hin make headlines when hin multi-million-naira Brabus B Jeep bin dey involved in accident.

As pipo don already know am for hin controversial actions, Portable again make waves on top internet as hin cover di fuel expenses of all di pipo wey dey for fuel station for Lagos, Nigeria.

Na so pipo just dey happy as hin act of kindness, touch dia heart. Also, pipo don flood di post comment section to share dia thoughts on Portable gesture.

 

FOR MORE NEWS: “To say ‘sorry’ for abroad fit put you for trouble” – UK-based Nigerian lady reveal

 

See some reactions below:

@abazwhyllzz: “Dis na exactly why most artists no like dis guy, He’s real asf. Portable for president 2026 soon.”

@toyor_pr: “We can see the good work Portable is doing. Portable’s govt is better than Tinubu’s.” 

@newsplug9ja: “How does he want to pay? Pay to the filling station and everyone will Be buying a specific amount of fuel? Or stand there and be paying for everyone one by one.” 

@PabloHoggs: “I feel he’s a generous person, but his razz attitude and controversial person won’t let people see.” 

@Ishow_leck: “His free lifestyle and showing love on the street is just so beautiful.” 

@black_izeek: “No one get street credibility like this guy. Portable is him.” 

You fit go see di tori watch di video….READ MORE