fbpx
May 2, 2024

At least 22 pipol don kpai for India after dey drink ogogoŕo (alcohol)

0

At least 22 pipol don change address go heaven and several others dey for hospital like dis like dis for India after dem drink alcohol wey government don ban, on Thursday.

Dis dealth mata happun for two villages inside eastern state of Bihar for india. where government no allow anybody to dey take alcohol.

U FIT ALSO READ NSIA don unveil platform to stimulate devts for Nigerian digital ecosystem

Alcohol ban dey for several Indian states, but pipol wey bin dey sell black market con make am cheap for pipol. alcohol for backstreet wey dem no regulate dey kill hundreds of pipol every year.

According to latest incident, some men for Saran district start to dey vomit on Tuesday bifore pipol go tok say wetin happun dia condition don worse pass wetin mouth go fit tok.

Three pipol die on dia way to hospital and others die during treatment on Wednesday and Thursday,according to report.

Di Hospital chief Sagar Dulal Sinha tok say like 22 test na hin dey don conduct so far ontop dis pipol but dey never get wetin really happun to dem.

Senior police officer Santosh Kumar tok say dey don give di order say make dem close down any shop we dem see say e dey sell alchohol wey government don ban for di area.

Hin tell AFP say “ Dey don arrest over a dozen of pipol wey dey sell ogogoro for di area and at di same time dey don detain some.”

Report tok say  na over five billion litres of alcohol dem dey drink every year for india, and around 40 percent are illegally produced, according to wetin di International Spirits and Wine Association of India tok.

Ogogoro liquor get methanol inside and e dey cause blindness, liver damage and dey quickly dey kill persin.

For July, 42 pipol na hin change address go yonda for western state of Gujarat after dey drink bootleg booze.

Last year, na about 100 pipol change address go yonda fo northern state of Punjab for di same similar incident.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *