fbpx
May 5, 2024

2023: Make una ensure free and fair elections, Biden tell African leaders

0

United States President Joe Biden on Wednesday met with all African nations leaders wey go do election for 2023, as hin beg dem to make sure say di election dey free and fair.

Dis summit na hin bring most African leaders to Washington, Biden and hin top aides met separately with six African leaders wey bin dey part of dia democracy push.

U FIT ALSO READ EFCC don recover up to N30bn from suspended Accountant-General 

Di group include Nigerian President, Muhammadu Buhari, President Felix Tshisekedi of the Democratic Republic of Congo who took office in 2019, Gabon’s Ali Bongo Ondimba, who don bi president since 2009 after hin succeed hin father, and the leaders of Liberia, Madagascar and Sierra Leone, na all of dem show face for White House.

Jake Sullivan, wey bi Biden national security adviser, tok say di meeting wey dem do with di presidents na to discuss on how di coming election go dey free and fair across di whole continent.

“ US dey readi to do everything within dia power to support di coming elections just to dey free and fair,” na wetin Sullivan, yarn tori pipol bi dat on Monday.

For September, United States don promise DR Congo $13 million to take support dia coming election and dem readi to fund pipol both locally and internationally wen readi to observer and those wey wan know as di election dey go.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *