fbpx
April 19, 2024

Atiku mourns; Osun PDP don suspend political activities because of di death of Davido pikin

0
Davido-son-don-kpai-

President candidate of di People’s Democratic Party, PDP, dey mourn di death of David Adeleke (Davido) son death, Ifeanyi.

Di Osun state chapter of di PDP follow suspend dia political activities for di state to mourn with di Adeleke family.

Davido, wey be di cousin to Osun Governor-elect Ademola Adeleke,  lose hin pikin after he drown for inside swimming pool for Lagos State.

YOU GO LIKE READ: 11 Home Safety Tips to Keep Your Family Safe

Di statement by Osun Caretaker Chairman of PDP, Dr Adekunle Akindele, express sadness because of di incident and hin pray with di family so that God go console them.

Rumors bin don dey spread everywhere about Davido Pikin, and pipo dey wonder if na true abi no be true.

With the update wey don drop so, and as PDP politicians suspend dia activities, e be like say di tori na true.

You fit enter Vanguard go read di full tori… READ MORE

For more News: Mama use hot knife design pikin body like Kampala on top Cigarette money

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *