fbpx
May 3, 2024

Supreme Court no confirm Tinubu as winner of 2023 election – Datti Baba-Ahmed

court-no-confirm-tinubu-victory

Labour Party vice presidential candidate for di 2023 election, Yusuf Datti Baba-Ahmed, don yarn say di Supreme Court no confirm di victory of Bola Ahmed Tinubu, contrary to di general belief

According to di former federal lawmaker, di apex court only uphold wetin hin describe as di illegality wey di Independent National Electoral Commission (INEC) declare.

Datti Baba-Ahmed yarn dis one when hin appear as guest on Arise TV on Monday evening, hours after hin boss, Peter Obi, address  di press on di outcome of di judicial process for di aftermath of di election.

 

FOR MORE NEWS: Adeleke congratulate Tinubu on Supreme Court victory

 

Hin yarn say hin reject di supreme Court judgement and hin no accept am as valid ruling.

Peter Obi bin go di apex court to challenge di ruling of di Presidential Election Petition Tribunal, wey uphold INEC declaration of Tinubu as di winner of di election.

Di apex court, for dia ruling, stand by di PEPT decision, and dem confirm say Tinubu na di duly elected president.

You fit go read di tori see why Datti tok say Court no confirm Tinubu victory…READ MORE