fbpx
April 24, 2024

Atiku talk say nobody fit force Ayu make e resign.

0
ATIKU-WIKE-AYU.

The Peoples Democratic Party presidential candidate, Atiku Abubakar, on Wednesday, talk say no party member fit force the PDP National Chairman, Iyorchia Ayu, make e resign.

This tori dey come after the hour wey the wahala wey shake PDP don worse finish on Wednesday as Governor Nyesom Wike team comot for Atiku campaign council.

YOU FIT STILL ENJOY: INEC don clear ground for Tinubu, Atiku, Obi, 15 others for 2023 poll

The member anounce their decision to comot for the council after the  meeting wey dem do on Wednesday morning for Port Harcourt, the Rivers State capital.

Dem talk say by force by fire, the PDP National Chairman must resign before dem change mind for their decision.

You fit CLICK HERE go read more of the tori for inside Punch.

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *