fbpx
May 8, 2024

Atiku’s camp don ready to settle with Wike and others over 2023 Presidency.

0

Di camp of di Peoples Democratic Party, PDP, presidential candidate, Atiku Abubakar,don come out tell everybody say di crisis within di party would be resolved ahead of di 2023 election.

Dele Momodu, di Director of Strategic Communication of di PDP Presidential Campaign Council, PCC, tok say di agitation of di G-5 governors would soon be over.

U FIT ALSO READ Presidency: You no be custodian of Rivers vote – Atiku attack Wike

Di G-5 governors comprise Nyesom Wike of Rivers State, Samuel Ortom of Benue State, Seyi Makinde of Oyo State, Okezie Ikpeazu of Abia State, and Ifeanyi Ugwanyi of Enugu State.

Di governors dey demand for di resignation of Iyorchia Ayu as the National Chairman of PDP say dem no want am for dat post at all.

Dem tok say Northerner no fit produce presidential candidate and at di same time produce National Chairman for di same party.

According to tori we hear say former President Goodluck Jonathan, don approach dem to reconcile all di gbege wen bin sele among di party members.

On Thursday for Abuja, Dele Momodu tok say Atiku’s camp don ready to reconcile with di governors.

Momodu yarn tori pipol say: “dem don dey try to see how dem go bring everybody back under di same umbrella of di PDP so dat wen raining days show water no go touch dia bodi

So hopefully, in di next couple of days and weeks, all of us go settle our differences and we will be able to work as one family.

Dele tok say PDP na di biggest political family in Africa, and we want make e remain like dat

To read di full tori CLICKHERE

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *