fbpx
April 23, 2024

Presidency: You no be custodian of Rivers vote – Atiku attack Wike

0
atiku-wike-votes-matter

Di Peoples Democratic Party, PDP, presidential candidate, Atiku Abubakar, don talk say Governor Nyesom Wike of Rivers State no be di custodian of votes for di State.

Wike bin vow say hin no go ever support Atiku; 2023 presidential bid.

Wike and five other PDP governors no dey happy with Atiku and di party leadership after hin lose di presidential primaries.

Di governor accuse Atiku sey hin dey back Iyorchia Ayu make hin remain as di party National Chairman.

YOU GO LIKE READ: How to Educate Yourself on a New Subject

Wike and some governors of di party talk say a particular region no fit produce PDP National Chairman and presidential candidate.

Di governor still accuse Atiku, hin talk say Atiku sideline am for di constitution of hin presidential campaign council.

Atiku sef react to di matter, hin talk say Wike no fit manipulate votes for Rivers State following di introduction of electronic voting.

This tori dey inside DailyPost, you fit go read di remaining…READ MORE

For more news: Another governor don threaten to comot for Atiku campaign

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *