fbpx
April 26, 2024

Babachir Lawal and Dogara: dey criticize me becos say i fall dia hand – Tinubu

0

Di All Progressives Congress, APC, presidential candidate, Bola Tinubu, don accuse those pipol wen dey criticize am base on say hin carry Kashim Shettima as hin running mate

Tinubu tok say seh una see those pipol wen dey criticize me so dem bi my close friends and bad belle pipol wen i fall dia hand wen dey come meet me say dey wan bi my running mate i tell dem say no say na Shettima i want.

U FIT ALSO READ Nigeria dey sick, Na Atiku bi di cure – Demola Olarewaju

Hin yarn dis one for one tok tok session with di leaders of di Christian Association of Nigeria (CAN) for Abuja, led bi Archbishop Daniel Ukoh.

Babachir Lawal, wen bi former Secretary to di Government of di Federation and close padi to Tinubu, don condem di APC Muslim-Muslim ticket.

Di bifore Speaker of di House of Representatives, Yakubu Dogara, don advice Christians to vote against APC.sake of say Tinubu decision to settle for a Muslim-Muslim ticket na wetin no good at all.

Some Nigerians don accuse Tinubu say hin wan Islamize Nigeria.hin tok say na big lie oo,hin tok say dst kind thing no even cross hin mind infact dat kind thing no fit happun.

Di APC presidential candidate tok say hin dey hear say pipol dey tok say him wan oppress Christians,hin say lai lai if di Christians no believe am make dem go carry Ogun come make hin take swear give dem

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *