fbpx
April 25, 2024

I sabi di root to Nigeria problem — Peter Obi

0

Di presidential candidate of di Labour Party, Peter Obi, don come out tok say hin know di root to Nigerian problem.

Obi yarn dis one for Rivers State on Thursday, wen di state governor, Nyesom Wike, invite am to inaugurate di Nkpolu-Oroworokwo Flyover, wen bi di ninth flyover of Wike’s administration.

U FIT ALSO READ 2023: I Be Di Hope Of Nigeria – Tinubu 

Obi tok say di root to Nigerian problem bi say di countri no dey productive.

Hin tok say hin don travel round di country and him knew wetin fit benefit every region, and him don know di necessary things wen him fit put in place for di as betterment of Nigeria.

On dat large crowd of popol for Port-Harcou, Rivers State capital,welcome peter obi and hin beg di pipol of River state to accept am as one of dia brother, and hin promise to support di people of River state.

Wike self con come out with hin black sun glass for eyes con tell obi say hin go support am on anything wen concern logistics matter for campaign for Rivers state.

“hin tok say hin know peter obi well well and hin get di sense and ability to lead di countri to where angels dey play gamble.

Datti Baba-Ahmed.self follow obi show face for di inauguration
Obi tok say hin don tell di pipol wen dey for North say hin go develop dia land for dem..

For South-West hin tok say dat place go bi di financial capital wen di money go dey come out and for East manufacturing of product go dey go on for dier

Obi promise to revive di sea port wen bin dey for River state so dat dem go fit dey use am for di exporting of goods.

To read di full tori CLICKHERE

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *