fbpx
April 20, 2024

Nigeria dey sick, Na Atiku bi di cure – Demola Olarewaju

0

Demola Olarewaju, di Special Assistant on Digital Strategy matter to di presidential candidate of di Peoples Democratic Party (PDP), Atiku Abubakar tok say Nigeria need president wen dey physically and mentally fit like Atiku.

Olanrewaju yarn dis one to tori pipol on Politics Hub,for Vanguard online TV show.

U FIT ALSO READ Court of Appeal don remove Akpabio as APC senatorial candidate

According to tori,Damilola Ogunsakin tok say PDP get high chance to win di 2023 presidential election ahead of other parties like APC.

Damilola tok say“Nigeria dey sick and na persin wen hin bodi dey healthy go fit manage persin wen dey sick, Atiku Abubakar na di medicine to Nigeria sickness.

Hin tok say “di pipol of Nigeria no dey confident of wetin di future of di countri go bi like” but hin dey assure dem say if dem fit support PDP everywhere go stew.

On top APC matter Olarewaju tok say di party make wrong choice of candidate, say na Yemi Osinbajo for bi di best choice to present to Nigerians not Tinubu.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *