fbpx
May 6, 2024

Bandit kpai Seven NSCDC officers, five others

Bandit or Bandkiller

Make we kuku call a spade a spade…. why call dem bandit?

Me go prefer call dem terrorist….dem no be bandit

Terrorist don killed plenti people for inside kuriga mining site for Birmin Gwari local government of Kaduna State. According to report wey enter our ear, we gather say nothing less than seven officers of the Nigeria Security and Civil Defence Corps and five others…police, soldier, and vigilantes, all this terrorist end their life for the tragedy wey happen for the mining site.

The Nigeria Security and Civil Defence Corps (NSCDC) dem don komot tell public say the report no be lie, na true say this terrorist carry chair sit-down wait our people for the site before the bandit open fire kill dem according to the NSCDC Director of Public Relations, Mr Olusola Odumosu.

The sad killing by the bandit happen on Monday 9th January 2023 around 10 am in the morning for the Kuriga mining site in Birnin Gwari LGA of Kaduna State.

Bandit: Wetin Oga NSCDC  Oga talk on the bandit matter

The Oga patapata for the Nigeria Security and Civil Defence Corps, Dr Ahmed Abubakar Audi, MNI, OFR too don Komot condemn the killing by the bandit as unfortunate and big loss for the Corps, families and friend of all wey die inside the killing for the site.

He follows shed tears with the family and pray say may God give dem strength to take bear the loss. He also adds join say may the Corps carry dia flag put for middle according to tradition to show say something wey bad don happen.

The Commandant general also talk say, make dem organized prayer, where Muslim and Christian go pray for the officers wey die and for protection for the others officer wey still dey work to defend dia papa land from the hand of bandit. This go happen for the NSCDC headquarters for Abuja.